See matches wey Dahane Beida officiate for this 2023 AFCON,hin stats, and why some Nigerians dey cry because say na Mauritania man plus video - Football In Pidgin

Header Ads

See matches wey Dahane Beida officiate for this 2023 AFCON,hin stats, and why some Nigerians dey cry because say na Mauritania man plus video

 


CAF don list di names of officials wey go dey incharge of Nigeria vs Ivory match tomorrow and officials wey go still dey incharge of South Africa vs D.R Congo today.


According to names wey CAF list, na Dahane Beida go be di center referee for Nigeria vs Ivory match on Sunday.


Dehane Beida get good records for this 2023 AFCON na why dem carry am as referee because dem need beta referee go handle this 2023 AFCON final match.

start by 9pm while South Africa and D.R Congo go battle for third place today and di match go start by 9pm today.


Why some Nigerians dey vex after dem hear say na Mauritanian referee go officiate di match

Why some Nigerians dey vex be say dem remember wetin happen for 1988 Africa Cup of Nations final wey Cameroon win Nigeria 1-0 for Morocco.


Di name of di referee wey officiate di match na Idrissa Safe and na from Mauritania, di referee give Cameroon penalty come still commot goal wey Nigeria score, according to him di goal wey Henry Nwosu score na offside but some people don check am come still tok say di ball no be Offside.


No comments

Powered by Blogger.