Breaking:APC chieftain, Cairo Ojougboh don die for where e dey watch Nigeria vs South Africa match yesterday
Some Nigerians don cry tire after dem wake up to a news wey say Cairo Ojougboh wey be former Presidential Adviser on National Assembly Matters to former President Goodluck Jonathan die for where e dey watch Super Eagles and South Africa match yesterday.
According to Sahara Reporters oga Cairo Ojougboh slump for where e dey shout after referee commot Victor Osimhen goal come give South Africa Penalty around 88′ mins.
Victor Osimhen bin score double Nigeria lead around 87′ mins but dem later commot di goal after VAR check wey show say Yusuf Alhassan foul Percy Tau for Super Eagles box and na from there South Africa equalize wey make di ball enter extra time from Extra time to penalty shootouts wey Nigeria later win 4-2.
As di time of this reports, di family of DR Cairo Ojougboh never confirm wetin kill am but a source wey dey close to hin family confirm say Cairo Ojougboh slump immediately referee give South Africa di penalty.
Incase you still don’t know who Dr .Cairo Ojougboh be, Ojuogboh na former House Of Representatives member wey represent Ika Federal Constituency between 2003 and 2007.
According to Sahara Reporters, Ojougboh na di immediate past Director of Projects on di Interim Management Committee (IMC) of the Niger Delta Development Commission (NDDC).
Dem born Cairo Ojougboh on September 8, 1959 in di Ika South Local Government Area of Delta State.Ojougboh na medical doctor and the Chairman and Founder of Ojougboh Foundation.
Post a Comment