Watch how Khadija Shaw take score di beautiful goal wey help Man City win Chelsea today and full match report - Football In Pidgin

Header Ads

Watch how Khadija Shaw take score di beautiful goal wey help Man City win Chelsea today and full match report

 


Manchester women don give Chelsea women their second lose of di season after dem win dem 0-1 for Kingsmeadow Stadium wey be Chelsea women’s home.


Di lose mean say Chelsea women’s 22 home matches unbeaten run don end and person wey follow end am na Khadija Shaw wey score di only goal wey Manchester City Women take win today.


Khadija Shaw wey be WSL top scorer with 14 goals play beta ball today against Chelsea soety some Man City fans come dey tok say dem suppose increase her salary because she too good.

Khadija Shaw score around 14 mintues after Jess Park collect ball from Erin Cuthbert inside Chelsea’s half come give am beta assist wey she use score.

Watch di goal here


E remain small make Chelsea equalize for 90′ mins but 19-year-old Man City goalkeeper wey be Khiara Keating do beta double saves wey deny Jelena Cankovic her gog Khadija Shaw make another attempt to score but Chelsea goal-keeper wey be Hannah Hampton no gree Hampton still do anoda beta save wey stop Chloe Kelly from doubling City’s lead for second half, while Chelsea two Chelsea players, Fran Kirby and Cuthbert still try their luck but goal still no enter. Chelsea fans still dey vex because referee no gree give dem penalty while some say make dem no worry say dem go win their next match. Di losing mean say Chelsea and Man City don dey di same points for Women’s Super League table but Chelsea dey first with 34 points while Man City dey second with 34 points too.

No comments

Powered by Blogger.