Watch how Abiam Nelson take score world class goal against Rivers United - Football In Pidgin

Header Ads

Watch how Abiam Nelson take score world class goal against Rivers United

 


Defenders work na to defend na few defenders sabi score goal but e get one particular defender wey dey play for one club for Nigeria Premier league wey dey defend come still dey score goal.


Meet di 22 year old Doma United defender wey im name na Abiam Nelson wey dey defend come still sabi score.


Abiam Nelson bin join Doma United from Nassarawa United last year September 2023 and na one year contract hin sign with Doma United, since then e just dey play dey help Doma United for league.

Since this season, Nelson Abiam don play 15 matches, score 5 goals, keep 10 clean-sheets no be only that one.


Nelson Abiam don collect 5 man of di match awards inside those 15 matches e don appear for Nigeria Premier league team of di week 7 times.


Although Ngeria Premier league football dey on break now but fans no fit forget di goal wey Nelson Abiam score against Rivers United.


Nelson score beta goal wey suppose collect Puskas award and e score di goal for week 19 of di Nigeria Premier league and na against Rivers United although di match later end 1-1.


Na Nelson Abiam score di equalizer wey help Doma United collect one point against Rivers United and e score di goal around 90’+3 and di goal still help Doma United enter 3rd position for league with 32 points.


Watch di match highlight and Nelson Abiam Puskas goal:


No comments

Powered by Blogger.